We’ve updated our Terms of Use to reflect our new entity name and address. You can review the changes here.
We’ve updated our Terms of Use. You can review the changes here.
/

lyrics

As for me I no be addict
I go fit to stop wen i want
Wen i say i've finally had it
I go turn ma back then change ma front
E no hard for me to break this habit
U dier at the right time
Allow me mek I chase this rabbit
To give me some peace of mind

Pusherman give me on credit
I go thank you long as I live
A big turkey dey com and I dread it
Coz e no dey come for thanksgive
Wen I appear people dey hide dem valuables
E no dey biz me no more
I go fit lie lie dem dey be so gullible
Den make away with som more

I no get dough to keep this lifestyle
Dey sack me from workforce
So I go teef teef small in the meanwhile
Till I dey back on course
I see say my family dey soffa
E b dem wey dem fool
I go take everything dey have to offer
I dey use dem like tool

None of your gods go fit to help me
Jesus seff be small boy
Iboga go fit to make me healthy
But I wan live like toy
If you no stop talk I no go stop take
Chale u dey chack me seff
I dey go od so I no go fit wake
I dey welcome ma death

As for me I no be addict
I go fit to stop wen i want
Wen i say i've finally had it
I go turn ma back then change ma front

credits

from Red Card - The Minstrel Cycle, released September 8, 2019

license

all rights reserved

tags

about

Wanlov The Kubolor Accra, Ghana

Wanlov the Kubolor is a visionary musician, producer, and filmmaker. He is an Akan from the Balkans. He wants freedom, justice, and love for all.

contact / help

Contact Wanlov The Kubolor

Streaming and
Download help

Redeem code

Report this track or account

Wanlov The Kubolor recommends:

If you like Wanlov The Kubolor, you may also like: